A MUST READ RAMADAN JOKE.
One day my papa call me, my
brother
and my mother
together and tell us say if we dream say
them wan give us something
for dream make we no
collect, say na enemies wan
give
us bad things. He say if we dream that kind
dream
make we tell am and he go
buy that thing wey them
wan
give us for dream for us. Two days later my brother
sleep for night dey mention
RICE! RICE!! RICE!!!, ma papa
wake am
say wetin dey
happen, he say them wan give am rice
for dream. My
papa give am #500 say make
he take eat rice. When i see
say the thing dey work... The
next day i start to dey shout
MR BIGGS!!! for night. Ma papa
say
wetin, i say them wan gimme
Mr Biggs for dream. My
papa gimme #1000 make i take eat Mr Biggs. Na so i do
wey
i take
buy my phone and
bicycle. But the one wey i do
wey i take spoil evrything na
for one night wen i dey shout
RANGE ROVER SPORT!!!, ma
papa wake up say wetin... I
say
them wan gimme RANGE ROVER SPORT for dream.
My papa say 'sleep make you
collect am. Lwkmd
No comments:
Post a Comment